Wia dis foto come from, Simon Leviev
The Tinder Swindler documentary don become major talking points since dem release am ontop movie streaming platform, Netflix.
Di documentary follow di tori of one con-man Simon Leviev wey dey scam women wey im meet on dating app.
Since di release on di film streaming platform, e don cause plenti tok-tok about dating fraud. E don also raise questions about who be Simon Leviev, wia im dey now? And wetin happun to im victims since dem release di documentary?
Meanwhile Netflix don also comot to tok about di true tori behind di documentary.
So who be di Tinder Swindler?
Im real name na Shimon Hayut, one convicted fraudster wey dem born for Israel.
Hayut dey use dating apps to meet multiple women, then im go collect credit and loans in dia names, afta im go leave dem wit plenty bills.
Hayut dey always jump from one identity to another in order to keep im scheme running.
Dem convict am of fraud for Finland under im birth name but im dey carry out im Tinder con under di name Simon Leviev, dey claim to be di son of wealthy diamond magnate Lev Leviev.
Once dem reveal im name for one VG expose, im supposedly take di name David Sharon make authorities no catch am.
Which kain scam im dey do?
Hayut dey follow one pattern: Im go match wit a woman on Tinder, take her on expensive and impressive first date and slowly build dia relationship as dem dey fly around di world and secretly dey date other women.
Im accusers claim say, at a…
